• Home  
  • South Africa mass shooting: 17 pipo dead for KwaZulu-Natal province and Pretoria
South Africa mass shooting: 17 pipo dead for KwaZulu-Natal province and Pretoria
- Africa

South Africa mass shooting: 17 pipo dead for KwaZulu-Natal province and Pretoria

Wia dis foto come from, EMMANUEL CROSET / AFP via Getty Images Published 16 November 2026 Read am in 3 mins South African police dey investigate di murders of 17 pipo in two separate shootings on Sunday night. Eight men dey fatally shot inside minibus for KwaZulu-Natal province. Police declare dem dead wen dem arrive

Published

Read am in 3 mins

South African police dey investigate di murders of 17 pipo in two separate shootings on Sunday night.

Eight men dey fatally shot inside minibus for KwaZulu-Natal province. Police declare dem dead wen dem arrive at di scene.

Hours later, dem find nine pipo shot dead inside a shack in western Pretoria.

Police say di two incidents dey unrelated. Di motive for di shootings neva dey established.

South Africa dey struggle to contain violent crime, including gang-related killings. Di kontri get one of di world highest murder rates.

Police say dem respond to reports of shooting ⁠outside Pietermaritzburg town for KwaZulu-Natal and find white seven-seater vehicle riddled wit bullet holes.

Inside na eight men wit multiple gunshot wounds.

“E neva dey established how di incident happun, and police dey collect pieces of evidence to determine di possible motive of di killings and di identity of di suspects,” police tok tok pesin Robert Netshiunda say.

Di police don launch manhunt for di suspects.

Two seperate shooting in South Africa- Oda times e don happun

For separate shooting in di Jeffsville informal settlement for Atteridgeville, west of Pretoria, police find di bodies of six men and three women.

Dem dey believed to dey killed inside four-room shack between 22:00 and 23:00 on Sunday.

Di bodies dey scattered across di rooms, wit several gun cartridges wey dem discova outside di shack.

Community members initially mistake di gunshots for thunder and lightning.

“Di provincial commissioner of police for Gauteng [province, wey include Pretoria] don mobilize di necessary resources, including di crime intelligence and di deputy provincial commissioner tracking team to search for di suspect,” police tok tok pesin Brigadier Brenda Muridili say.

INo be di first mass shooting for di area. For January, five men dey shot dead outside local shop in broad daylight.

Illegal firearms dey widespread for South Africa, wia gun violence remain persistent problem, increasingly involving mass shootings.

for September, 28 pipo dey killed in two separate cases.

Eighteen pipo dey killed wen eight gunmen storm one bar near Johannesburg and open fire on 25 September. Fourteen odas dey injured.

For separate shooting di following day, 10 pipo dey killed outside entertainment venue township near Cape Town. Anoda 11 dey injured.

Much of di violence dey linked to turf wars between gangs wey dey involved in drug trafficking and illegal mining.

For February, President Cyril Ramaphosa describe organised crime as “di most immediate threat to our democracy, our society and our economic development”.

Earlier dis year, di military dey deployed alongside police to five provinces wit di highest murder rates, including Gauteng, for effort to tackle armed violence.

According to di latest police statistics, 5,427 pipo dey murdered nationwide between April and June 2026, an average of about 60 killings a day.

Dis na 6 per sent decline compared wit di same period a year earlier.

Additional reporting by Christian Parkinson in Johannesburg

Source: www.bbc.com

About Us

Toolq Media Is a Global News Platform Covering the Latest Developments and Breaking Stories from Around The World, Including World News, Business, Finance, Technology, Health, Politics, Science, Entertainment, Sports, and More.

Toolq

Toolq @2026. All Rights Reserved.